
abudulahi - mg pablo lyrics
verse 1
abdullahi tell me why * why you had to go…
i still remember promises you made to mama years ago
abdullahi na my guy * n*gga wey dey calm…
he be cooler than an ice mehn * this n*gga no get qualms…
abudulahi no get time * but he dey like some watches…
financially he fit red but steady e dy eye those porsches…
when he dy the dark na allah dey shine he torches…
started on the right foot * nah hе never needed clutchеs…
abdullahi na from the street * you suppose know how e dey be…
mumsy dey work for gov * most times dem find am hard to eat…
abdulahi the only son * and he get like 3 sis…
he don drop out from school * since through primary 6
abdulahi too dey smart and he loyal as he be…
so one egbon for area don dey chuck am with the pin…
don dey send am all the kpo * don dey send am all the trees…
i no believe my eyes first time i see am smoking trees…
abdulahi still too young * all of us dey like 14…
but he no dy sleep for house * dem no dey see am for like weeks..
the last time i see am he say he go try to change…
but e no dey let am do cause egbon dey give am change…
i know say you gats survive * even me i no fit feed you…
but no put your hand * for anything wey go k!ll you..
he tell me say gvdafi calm down* you too dey bother…
if i dull like you dey tell me * who go come dey feed my mother…
shortly e never too tey abdulahi don dey push…
every kind of drugs * plus e don still enter bush..
he tell me make i follow up * he say i too dey goof…
say the goal na to stack the papers till e break the roof…
my n*gga don be druggie now he dey do ice and coke…
he said i rather rich and die young than living long and broke…
as he dey clear me how e be * i swear my eyes dey soak…
cause this n*gga be like bro to me * and i love am no be joke…
i still remember when he tell say dem k!ll one of he guy…
i saw his heart gettin cold * i see the fears up in his eyes…
he say i for don craze if no be say me i dey high…
he say like 5 n*ggas must drop for him n*ggas when dem kpie…
gang life na him family * and drugs be his escape…
every night he dy stay awake * dey think about he fate…
him mumsy don notice for long * every night na she dey pray…
but evil wey he do for night must catch up by the day…
one faithful night like that * we dey our bed dey sleep…
when we heard several gunshots * bullets dey rain for our zinc…
we think say na armed robbers * so we hurry call police…
but dem no agree to come * dem put the line for busy…
i almost die from fear that night * non of us fit sleep…
the thing affect so deep * now i get ptsd
straight i go down on my kneels * pray the lord my soul to keep…
i look my mumsy for her eyes * i observe say she dey weep…
day break everywhere calm * some people gather down the street…
for my mind na wetin sup last night dem dey reason for real…
now i say make reach there * so i go know what’s up the deal…
as i dey get close * who i see na nurudeen..
na him come chuck me the pin say my n*gga man don go…
as i step further * i see my n*gga man for cold blood…
e pain me reach my bone when i see him mumsy dey groan…
plus him 3 sis dem dey cry without control
abudulahi why you go…
abudulahi why you go like this?
Random Song Lyrics :
- pare pra pensar - quintal do mundo lyrics
- she called me diaval - chris harms lyrics
- clear - lil rob lyrics
- dance with your ghost - grayscale lyrics
- one way - drae ki lyrics
- wigilia 1983r. - polishdoc lyrics
- binua - maua sama lyrics
- bodybuilt - zootzie lyrics
- hoe heet dat liedje? - chris bauer lyrics
- i'm all that - deja lyrics