
who’s real - mg pablo lyrics
verse 1
how you want take know who be goat * when them wear sheep clothes…
if dem no disguise dem no go fit come close
how you want take know who be zobo * when dem be like blood…
thrive carefully bro the streets is cold
you be my blood where u dey when e red for me * you disappear like ghost when e set for me…
or better yet you stab my back wan throw me overboard…
left me drowning sinking in a pool of blood…
una dey make me wan dey doubt if love truly exist…
i hear the love in ur lips but the hate persist
when you no dey with me like this i dey miss you die…
unknowing to me for heart you dey wish me kpai…
tell me who’s real in a world where the fake is norm…
is like a bird k!llin bird for a piece of worm…
my heart dey broken and torn * i need some time to heal…
and anytime wey i hear love i dey get ptsd
chorus
i don’t know who’s real and fake * i just pray to the lord my soul to save…
i don’t wanna go to early grave * good life and the riches be the ish i crave…
tell me who’s is real now ahh eh!!! x2
verse 2
if cain fit k!ll abel for baba god blessings * imagine wetin he go do for ordinary settings…
even for church pastor no trust ushers with offerings…
n0body wan loose guard * the reason we suffering…
i dey play ps4 one cool evening for crib * when my phone ring i check na my guy kassim…
he tell me say make i fall out come lap our usual spot..
say everything dey the background * plus my favourite pot..
na once i wear my jean and shoe make i burst out from code..
as i fall out i notice some men across the road…
as a sharp guy i know say the settings no clear…
i took the next turn * make i discharge commot for there…
na so dem troway follow me * na jah save me that day…
i for no live to burst the verse wey i dey spit today…
moral of the story * survive no matter what it takes…
and cut your grasses so you go fit expose the snakes…
Random Song Lyrics :
- shadows - blasterjaxx lyrics
- peace of mind - skepta lyrics
- handling mer än ord - leviticus lyrics
- curious - alex zink lyrics
- welcome back mr. mac - saysothemac lyrics
- lying - dan + shay lyrics
- love sick - [deleted artist] lyrics
- meeting fate - thundersj lyrics
- ohne dich - medi67 & mudi lyrics
- как до луны (drizzy flow) - платина (platina) lyrics