lirikcinta.com
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu ogbonge solution – abiodun odesola

Loading...

when god dey hope go dey
when god dey solution go come
when god dey wahala go go
when god dey
jesus na the ogbonge solution man
na him be kakaraka promise keeper
e no dey tire e no dey faint
e no dey play me wayo
jesus na the ogbonge solution man
na him be kakaraka promise keeper
e no dey tire e no dey faint
e no dey lie (jesus christ)

healing go come blessings go follow
food go dey jaburata money go flow yafunyafun
healing go come blessings go follow
food go dey jaburata money go flow yafunyafun

your palava be say people no dey see your face
everywhere you go people no dey give you face
make una no think am too much make u no k!ll yourself o
very soon people go celebrate you
problems dey for your pocket e no gree comot
poverty sef e dey live with you
the only solution to this na to come to jesus
one by one e go solve your problems
healing go come blessings go follow
food go dey jaburata money go flow yafunyafun
healing go come blessings go follow
food go dey jaburata money go flow yafunyafun

you don marry tay e be like say no pickin
make una remember sarah with hannah
jehovah god wey bless them with pickins
e dey alive e go bless you too
mighty god e dey gidigba jesus na solution man o
he no dey taya he no dey fail
don’t give up he go bless you

healing go come blessings go follow
food go dey jaburata money go flow yafunyafun
healing go come blessings go follow
food go dey jaburata money go flow yafunyafun

you don try try so tay you don dey tire
e come be like say nothing dey work for you
you waka go north south east and west
everything still na scatter scatter
come to jesus today e go helep you
jesus e dey kampe
e go heal you e go bless you
don’t give up e no go tay
healing go come blessings go follow
food go dey jaburata money go flow yafunyafun
healing go come blessings go follow
food go dey jaburata money go flow yafunyafun

people go celebrate with you everyone go jubilate with you
people go gather dem go sing together praise the lord
whatever you are facing right now these problems go disappear
i am sure you go make am again
don’t lose hope don’t give up don’t worry
you go make am very soon very very soon o
you go dey sing e se e

healing go come blessings go follow
food go dey jaburata money go flow yafunyafun
healing go come blessings go follow
food go dey jaburata money go flow yafunyafun

lirik lagu lainnya :

YANG LAGI NGE-TRENDS...

Loading...