lirikcinta.com
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu hate, pt. 2 – basketmouth

Loading...

oya lets go
lets go
boy you talk sey you hate eme music
no be eme music you dey listen to
na eme music be this
yes na
ehn ehn na my sister go don put am inside
i dey try check the thing since sef
why you no go check am
the cd player don spoil
that’s why i just leave am there
okay but you they nod your head to the music
i just say catch you now you dey nod your head
i no nod my head
i get neck problem
my doctor say make i dey nod head
evеry time wey the thing dеy pain me
sey the pain go dey go
men
but you’re nodding your head to the beat
the beat
yes
no him say make i dey nod am to any beat wey i hear
sey he go make the tone rhythm
okay why you no off the radio
me off the raido
look see ehn no dey ask me
no dey ask me this kind thing
as i dey hear this song
i dey hear this song so
i won don go jam person now
so you dey annoy me
because of music you go jam person
i hate this eme people
i hate them
i no just like them
you sef why you dey ask me question
why you dey ask me question
you know what
i won
you know commot for my motor
commot for my motor
commot from this motor
oh boy na me na
na me get this motor
na your motor
ehn ehn
you know what
i won commot
i wn commot from this motor
just pack
inshort na me dey drive sef
make i pack

lirik lagu lainnya :

YANG LAGI NGE-TRENDS...

Loading...