lirikcinta.com
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu full stop (alright) – degoldberg

Loading...

intro
no put fullstop for place wey god just put a comma
no go give up for place where god just start with you my brother
yeba!

verse 1
my brother man, na you be this?
wetin happen wey your face be like this?
na because of all the gbogbo ti gbo join with the kasala you no get money to pay your bills

you k!ll yasef, wetin you gain?
shey the condition go still remain the same?
hypertension and bp worry worry fit kpai man
and matter sef e kuku no go change

and papa god, he get a plan
you get to understand himself e no be man
he no dey fail kpata*kpata as long as you believe wetin him been dey tell you
everything go dey him hand

no dey fear, make you relax
i dey tell you wene mmekpenhi go pass
and if you be like say the water don dey pass garri
make you take am easy hear the better advice

pre chorus
no put fullstop for place wey god just put a comma
no go give up where god just start with you my brother
no put fullstop for place wey god just put a comma
no waste your life for nothing
las las you go dey i say…
chorus
alright (alright)
okay (okay)…
“repeat chorus”

verse1
oga madam, ma wetin dey sup
why you be like who the world dey on top
shebi na because of that brother wey don leave you after many many years
when he promise say him love

but at the end, he break your heart
the brother tuwamana just like that
but remember say that disappoinment na for reason say the better man dey come in advance

no dey fear, stand up on your feet
know that what’s gonna be gonna be
and believe say na god fit send a better person wey go cherish and love you for who you be

for many years, you never born
and your mother*in*law don begin dey come
she don dey wonder when you go carry your pikin but no worry w no go tay very soon e go be your turn

know your friends number one and number two
for your front dem go ask you “how are you?”
you go tell dem all your story how e happen
for your back dem go use you go dey dance skelewu
no dey fear, make you relax
i dey tell you wene mmekpenhi go pass
and if you be like say the water don dey pass garri
make you take am easy hear the better advice

pre chorus
no put fullstop for place wey god just put a comma
no go give up where god just start with you my brother
no put fullstop for place wey god just put a comma
no waste your life for nothing
las las you go dey i say…

chorus
alright (alright)
okay (okay)…
“repeat chorus”

postlude
amaka how you dey (i dey okay…i dey alright)
haruna how you be (i be okay…i be alright)
chibuoso how you dey (i dey okay..i dey alright)
no matter how you be, big bros i tell you
las las…we go dey alright

lirik lagu lainnya :

YANG LAGI NGE-TRENDS...

Loading...