lirikcinta.com
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu industry nite (refix) – erigga

Loading...

na if you hear say i die say person shoot me
will you cry or say na wetin my mouth put me
what if you hear say na one robbery when i go
cause i don tire for underground i just wan blow
shoot videos wen bad like them daddy yo
put am for trace hip tv and mtv yo
oliru o sunday scatter g twelve bar
enter cotonou go buy like 20m car
na in those days these talents fit blow you
nowadays without money n0body wan know you
presenters with their share even dj’s too
100k each which show these upcoming dey do
get the nerve say erigga shoot with clearance
under this recession how much dey the balance
the industry for nigeria be like campaign
share the money pdp if you wan reign
e be like say nah endors*m*nt be the new swag
even if money no follow you fit take am brag
label dey spend big money for artiste head
but the artiste no go show many artiste dead
now for you too live the label be like like concrete work
very hard because of wetin dem don spend on top
cos your boss dey expect hundred million
after all this song blow were the hundred million
my label don cast e don go to g back
word on the street dem collect the house and jeep back
same girls when dey dance when dey hear your beat
na dey take you do yeye when they hear your gist
welcome to industry nite
na you dem dey host today you go perform right
for your mind all these men when dey here love you
but when dey reach their house dem go judge you
welcome to industry nite
na you dem dey host today you go perform right
for your mind all these men when dey here love you
but when dey reach there various houses dem go judge you
i swear down mehn the fake industry we have right here mehn
fake likes fake followers fake views mehn
but any how sha l can’t just leave you stranded
so l gat to bring in the real you know what am saying
a trip to the south you no need visa
king of the south to your door like domino pizza
the way my rap big i dey fear make you no drown
one stop to my money long pass devil gown
a trip to the south ep use your eyes listen
and mouth look better learn the industry is missing
rappers dey fear dem no believe say i go blow one day
heart dey beat anyhow like who follow one way
if na beef you dey find i shade am like suya
salamaleku my kalagbero reply puya
tell your producer orhh
use eim number text you
say better beef dey you come studio we mess you
na me na own the throne you just dey stone the throne
na street catry am give me i no fit bone the throne
my teacher tell me say na army gun go shoot me die
but instead na clearance dey shoot me guy
the day anonymous call me i dey jungle dey smoke
sign contract i never start industry don dey smoke
i don big pass who dey write na straight from my head
commot your leg for wire warri say abegg

lirik lagu lainnya :

YANG LAGI NGE-TRENDS...

Loading...