lirikcinta.com
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu beans – m_style

Loading...

intro: m_style omoebiekuru sweet song gang
verse 1
i rather work than for me to sit-down dey look
no go reason the cover take go judge the book
street don gbolo everywhere don rask
but government still dey worry us to pay our task
bad belle for my street omo dem too plenty
their plan na for your pocket to dey empty
baba god abeg make you no vex for me
i be your pikin i know you want the best for me
na everyday we dey hustle for naija bet
cos of the economy problem when be say naija get
tinz don hard ma-le sef dey play lotto
survival i swear na be the street motto
the street dey so strong omo you gats survive
na m_style dey kap i hope you dey feel the vibe
n-gg-s dey corner dey plan to end your life
your own padiman dey plan to bend your wife wtf
chorus
omo you think say na beans x3 (no be beans) x2
you gats work hard make money dey your jeans
verse 2
na every night and day na i still dey pray
cos this life your best friend sef fit betray
na by the grace of god na i take dey live
the street no dey friendly omo you gats believe
no be who first call police na dey win the case
na slow and steady i swear na dey win the race
every day i dey the hood just dey find my bread
under the hot sun see the way my eyes dey red
as long as god dey omo my hope too big
tinz full my memory e be like say na 2 gig
the hanz when i dey give you omo na concrete
without money your life no fit dey complete
some of my n-gg-s dey ghana dey chop sh-t and c-ke
because of money dem no wan even take am joke
running helter/skelter all because of red barret
and if dem catch you my brother na prison direct
repeat chorus
dem no dey wish me luck dem want make i suffer
dem even talk say i no get anything to offer
dem say we be bad boys say we be cultists
dem dey claim sense like say na dem be tortoise
but rest in peace to all the real n-gg-s we don die
this struggle no easy i just dey one side
i still dey worry with my music for this planet
cos na only baba god na give me this talent
bad mind people plenty and dem want hide is
oluwa dey involve na only him dey guide us
pikin dey road dey come how i want take feed am
like yung6ix plenty money me sef i need am
izibe work deli kpo street boys just wack
eni bodi gagala wor me i no wan lack
this song na for the street make dem feel am
the kind wound i get na money go fit heal am
repeat chorus
outro
oboy biggysmallz dis n-gg-s dem think say na beans o dem
never know say na fifteening we dey take chop is m_style
omoebiekuru signing out kellz on the mix

lirik lagu lainnya :

YANG LAGI NGE-TRENDS...

Loading...