lirikcinta.com
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu mama pray – pluto (ng)

Loading...

[intro]
mama pray, mama pray
my head ooh, my head ooh

[verse 1]
mama pray for me, pour oil for my head
your pikin don dey go, make i go well
if i dey crossroad, make i cross well
if i wan carry kele, make i carry well
if i jam crossroad; make i pick well
when water scarce, i go see well
make i hear bell, when trouble dey road
sapa hold others, e no go hold me
as i dey leave home, to go feed home
i no go call home, say i no fit feed oo
many years from now, na from grass to grace, rags to riches, come friends and bentleys

[chorus]
mama pray, mama pray
my head ooh, my head ooh
mama pray, mama pray
my head ooh, my head ooh

[verse 2]
mama pray for me, pour oil for my leg
your pikin don dey go, make i waka well
no go waka go, where i no suppose go
olopa dey pursue, make i run well
fence dey my front, i go fly well
if dem dey east, make i dey west
if dem dey north, make i dey south
when them dey down, i go dey up
if dem dey dessert, make i see dam
see my hustle pure, but them no send
them wan collect my own, con go sleep well
them no go breathe well, them no go sleep well
[chorus]
mama pray, mama pray
my head ooh, my head ooh
mama pray, mama pray
my head ooh, my head ooh

[verse 3]
mama pray for me, disturb god for me
when december come, i no go cover face
if i come house again, i no go trek again
all hustle na bargain, make we see gain
if we no feed the fam, wetin we gain?
make we see sun, make we fit ace
for daytime, we go see sun
when the night come, we go still see sun
any path i take, make baba pave am
any call i make, make baba link am
any track i make, make the djs play am! make the people love am! make the city rock am!

[chorus and outro]
mama pray, mama pray
my head ooh, my head ooh
mama pray, mama pray
mama pray, mama pray

my head ooh, my head ooh
pluto in your speakers

lirik lagu lainnya :

YANG LAGI NGE-TRENDS...

Loading...