lirikcinta.com
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

lirik lagu my car – tony tetuila

Loading...

tetu, where you dey go
wetin you dey go
wetin you dey find
why u dey ask me that kind question
say where i dey go

you don hit my car, oyinbo repete
i say, you don bash my car, gbese repete
tell me, you don hit my car, oyinbo repete
as you don bash my car, gbese repete
wetin you dey find
where you dey go
as i dey walka dey go like so
me, i am looking for this paddy
this paddy owe me plenty money
they tell me say they dey ikoy
me i get (yidis) for one party
seri paddy yen, ofe pa mi
today na today, no time for story
tinba dele re, ti n gba mu
he must pay me all the money
i come reach him say
i come see say
people gather dey just dey cry
i try to know wetin cause the cry
they tell me say my paddy don pai
as i con dey go back to my house
i come meet small hold up for road
the next thing wey i hear for my back
na one scratch from another car
ehn ehn

you don hit my car, oyinbo repete
i say, you don bash my car, gbese repete
tell me, you don hit my car, oyinbo repete
as you don bash my car, gbese repete
see, me see trouble ooh, another day again
dead body no dey pay person money
another paddy don dey bash my car
today na today, no time for story

ah, eedris, na u, see wahala
hey, whatsup, tony, whatsup man
ebe long time, wey no see, whatsup man
ol boy, stop that yarn o
wetin be whatsup
you bash my car, you dey tell me say whatsup
shey na whatsup i go use spray my car
i beg pay me my money

police con come dey measure the line
they say make i no worry, everything go be fine
they turn the papers say i make sign
i sign my own, eedris sign im own
i con dey whether who get the fault
they say na my paddy get the fault o
i pack my car, see trouble
yanga dey sleep, trouble come wake am
he he

you don hit my car, oyinbo repete
i say, you don bash my car, gbese repete
tell me, you don hit my car, oyinbo repete
as you don bash my car, gbese repete
huhh
somebody o, somebody wey
you don kissin ni, bobon kolo
shey na girigiri you dey take drive car
shey is good
somebody wey were, bobon kolo fit kolo
begin dey drive car ka kai kai
don kolo, girigiri

another wahala to carry for head
money no dey pocket for man to spend
one of my paddy wey dey owe me money
i reach im house, they say he don pai
another don dey bash my car
wetin i go do, e no get money
i con think say this stress no worth am
today be na own, tomorrow fit be my own
i go tell my paddy
make he come dey go
help me to push my car from road
as i push am small, wetin i see
na government car come bash my car
again

you don hit my car, oyinbo repete
i say, you don bash my car, gbese repete
tell me, you don hit my car, oyinbo repete
my own don better o, owo repete

you don hit my car, oyinbo repete
my own don better o, owo repete
tinubu, you don hit my car, oyinbo repete
my own don better o, owo repete

tinubu, you don hit my car, oyinbo repete
my own don better o, owo repete

tinubu, you don hit my car, oyinbo repete

lirik lagu lainnya :

YANG LAGI NGE-TRENDS...

Loading...